Goment close biggest food market for south west Nigeria

Authorities for Oyo state south west Nigeria don close down Bodija market inside Ibadan afta kasala happen for dia.
Oyo State Commissioner for information, Toye Arulogun tok say goment close di market afta cow seller dem clash with security agents wey come force dem to move go dia permanent site.
One of di butchers wey tok to BBC, accuse di Oyo state butchers association leaders say dem don collect bribe from goment to support di relocation order.
Bodiga market na di largest food market for south west Nigeria.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post

Oyo State director for bureau of investment, Yinka Fatoki say di goment don dey discuss wit di butchers association on how dem go run abbatoirs and also sell meat.
Former governor Aloa Akala bin build di new cow market outside Ibadan and di sellers no gree move becos dem say di new market too far.
According to one eye witness wey no wan appear for camera, im claim say four pipo die from stray bullets from security agents.
Some of di butcher dem bin don move go di new site, but many of dem bin still remain for Bodija.
End of Di one wey oda users dey read well well













