Nigeria no be headquarters of poverty - FG

Wia dis foto come from, Getty Images
Federal Goment for Nigeria don reject report wey claim say Nigeria don enta number one for poverty level for di whole world.
Brookings Institution wey be nonprofit public policy organisation for America bin report say Nigeria don overtake India as di kontri wey get di highest number of poor pipo for 2018.
Brookings say na every minute 6 pipo dey enta poverty for Nigeria. Di report tok say na 87 million pipo poverty dey worry for di kontri, but for India, na 73 million pipo dey poor.
Minister of Trade and Investment, Okechukwu Enelamah tok say, di factors wey dem use do di report na from wen Nigeria still dey recession.
Enelamah gree say Nigeria get serious unemployment palava but wit di kain work wey di present goment dey do, poverty go soon disappear comot for Nigeria. Di minister tell Nigerians make dem no allow di report worry dem.
High unemployment na one of di main tins wey dey cause poverty for Nigeria.







