APC National Convention: 6,000 delegates, 5,000 Police gada for Abuja

Members for Nigeria All Progressive Congress (APC) ruling party no send di Saturday morning rain as dem dey gada gidigba for Eagles Square Abuja, Nigeria capital for dia national convention.
Adams Oshiomhole, wey be former govnor of Edo state, south-south Nigeria, na di new national chairman of di party.
Chairman of di national convention committee and Jigawa govnor, Governor Abubakar Badaru Mohammed of Jigawa State, na im confam am for convention ground for Abuja.
Mr Oshiomhole name na di first candidate wey e mention and wen e ask delegates weda di former govnor dey 'unopposed' to be chairman, na so pipo shout 'Yes'.

Tori be say President Muhammadu Buhari dey support Mr Oshiomhole to become chairman.
Di party get 65 positions candidates fit contest even though di party cari keep 20 of dis positions keep sake of say only one candidate don come out to contest am.
E mean say e go come remain 45 offices wey dem go elect new members.

Delegates wey reach 6000 from 36 states and Abuja come di convention to follow do di election.
End of Di one wey oda users dey read well well
Security pipo block major roads wey enta di Eagles Square venue for di election.
Police say dem send 5000 officers, two helicopter and six armoured motor to do security for di venue.
















