Why local rice cost pass foreign rice for Nigeria

Rice farm for Kano

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Local rice farmers for Kano state.
    • Author, Fiona Equere
    • Role, BBC News Pidgin

If Nigeria close dia border, rice smuggling go increase well-well, na wetin rice dealers tell BBC Pidgin as goment say dem go close border on top smuggling palava.

Agriculture minister for di kontri, Audu Ogbeh, bin tok for one conference for capital, Abuja, say neighbouring kontris no try at all di way dem dey allow smugglers cari illegal rice enta Nigeria.

President Muhammadu Buhari don cari agriculture for head since im goment enta office for 2015.

Dem don spend plenti moni to ginger local farmers and local production sef don increase.

But local dealers say na foreign rice still dey move market pass and di local rice too cost.

"Dis move wey goment wan don go only increase smuggling and give di smugglers more money wey go lead to increase in price becos for Nigeria, pipo dey always find way to take go around tins."

Dat na wetin Oluwanishola Obisesan, wey don dey do rice business tey tey for Lagos, tell BBC Pidgin.

"For me e go hard but e go mean say di price of rice go go up well-well"

Obisesan say she no tink say di local rice production go fit meet di demand wey dey market.

Nigeria Jellof rice

Wia dis foto come from, NDUDU BY FAFA

Nigeria goment dey provoke for dia neighbours wey dey allow smugglers push rice enta.

"Our West African neighbours no dey try at all ontop di imported rice mata."

Na wetin Joseph Attah, Nigeria Customs Service tok-tok pesin tell BBC Pidgin.

Attah say "di kain ogboju wey authority dem for our neighbouring kontris dey do dey affect our national food security and na serious threat to our kontri".

"And e fit lead to decision to close our border. Wetin I mean na di smuggling of rice and cars dem inside di kontri."

Nigeria goment dey worry say all di moni wey dem don put inside rice farming for Nigeria go scatta if smuggling no stop.

Local rice cost pass di foreign one

Stocked bags of rice ready for transport to market for sales.

Wia dis foto come from, Chukwukajustice

Wetin we call dis foto, Local rice cost pass di foreign rice for Nigeria.

But Solomon Adetunji, wey be local rice farmer from Ado Ekiti, south west Nigeria say plenti pipo still like foreign rice pass local o

"Because e don dey market tey tey."

But im say tins don dey change small, as pipo now don dey appreciate local rice because beta dey inside.

Adetunji say di major problem na di price. Local rice cost pass di foreign one. Im say dis move wey goment wan do go help save di local rice industry.

But up till now, goment neva tok di particular kontri border wey dem wan close.

Shola say she feel say di whole tin na arrangee to help some pipo to make more money and di truth be say di quality of our local rice no reach di imported one.

"One rice wey I buy from Nassarawa na so-so sand, dirty and shaft full inside and pipo no buy am."ne.