Two brodas convert cassava waste to electricity for Ghana

Wetin we call dis Video, Meet boys who dey convert cassava to electricity
    • Author, Favour Nunoo
    • Role, BBC News Pidgin, Ghana

Two brothers who dey Eastern Region of Ghana afta introduce innovation for Ghana for di first time as dem dey generate electricity from cassava.

James Ansah den Kwesi Ansah produce dis innovation which dem dey call 'JK2 table power' from ordinary items for dema backyard like plastic gallon, wood den copper wires.

Cassava be popular West African root crop which people dey use for various starch based meals for di sub region inside.

Sake of farmers dey produce more cassava than what meners dey consume, plenty cassava waste dey di system inside but with dema innovation people go fit now use cassava waste charge phones, power bulbs, radio sets den stuff.

BBC Pidgin Reporter Favour Nunoo meet plus di two brothers who display di innovation which make dema has neighbours start dey see cassava in a different way.
Wetin we call dis foto, Kwesi and James display di innovation which make dema neighbours start dey see cassava in a different way.

James den Kwesi say with support from government or private sector dem fit convert most of Ghana's cassava waste into cheap electricity supply for schools, hospitals, villages den all persons who no get electricity for Ghana.