Beyoncé, Jay-Z 'Everything Is Love' new album don land

Beyonce and Jay-Z perform togeda for stage during dia 'On the Run II' Tour for Hampden Park on June 9, 2018 for Glasgow, Scotland.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di songs for di new album talk about mata like cheating and allegation say Jay-Z get pikin outside
Read am in 1 mins

Beyoncé and her husband Jay-Z don collabo to drop new album wey dem title "Everything Is Love".

Di album wey get nine songs na di first album wey dem join hand do as husband and wife under di name 'the Carters'.

For 2002 wen dem never marry Jay-Z and Beyoncé do dia first collabo song Bonnie and Clyde.

Di American celeb couple announce di album for stage during dia On the Run II concert for London Stadium in di UK on Saturday, where di big screens begin flash "album out now".

Na Beyoncé first post di news ontop her Instagram and Twitter wey make her fans begin ginger.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

Di last album wey Beyoncé release na "Lemonade," where she use style talk about how her husband bin dey cheat.

But last year Jay-Z release im own album "4:44," where im defend imsef against im wife accuse. Di album later get eight Grammy nominations.

Jay-Z and Beyonce Knowles perform on stage during dia 'On the Run II' tour for Principality Stadium on June 6, 2018 for Cardiff, Wales

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Beyoncé and Jay-Z marry on 4 April 2008