SARS mata don make Nigeria Police sack three officers afta online video go viral

Wia dis foto come from, Getty Images
Nigeria Police for Lagos don sack three of dia men afta dem find dem guilty say dem spray tear gas on top asthma patient.
Lagos Police Public Relations officer, Chike Oti say, dem try do orderly room trial for di three policemen wey bin use tear gas on top Ademuwagun Solomon near China town for Lagos.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Video wey show as di attack happun, wey dem call "SARS Operative shoot one man wey dem label fraudster for Ojota" , catch fire for social media.
But police deny say na shooting, dem say tear gas na im make Ademuwagun get asthma attack.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Di policemen wey dem dismiss na Inspector Momoh Sulaiman, Sergeant Emmanuel Monday and Sergeant Adamu Usman.
Oti tok for statement say dem dem don also collect dia work kit from di two sergeants but dem don forward di dismissal of di inspector go Assistant Inspector General of Police for Zone 2 for approval.








