Nigeria: How Vice President Yemi Osinbajo escape helicopter accident

Read am in 1 mins

Nigeria Vice Presido Yemi Osinbajo escape accident on Thursday for Abuja, di kontri capital.

Tori be say wen di VP wan leave di graduation ceremony of officers for Nigeria Customs Command and Staff College, Gwagwalada Abuja, e no reach 15 seconds for air afta take off di helicopter im enta begin comot smoke.

Na so di chopper do emergency landing; e land quick quick. As di helicopter land dem escort professor Osinbajo enter motor wey carri am go back state house.

Di Vice President tok tok pesin Laolu Akande later tweet wetin happen but im no gree tok about di emergency landing.