Kwesi Arthur get Ghana first 2018 BET nomination

Kwesi Arthur

Wia dis foto come from, Kwesi Arthur/Twitter

Wetin we call dis foto, Di music na fast rising star for di West African kontri
Read am in 1 mins

Ghanaian rap artiste, Kwesi Arthur famous for en hit song 'Grind Day' get nomination for di Black Entertainment Television (BET) Awards, 2018.

Di talented artiste get di nomination under di Viewer's Choice "Best New International Act" category for di BET awards.

Dis be Kwesi Arthur en reaction afta he receive di news of en nomination.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Dem nominate am alongside Mc Soffia (Brazil), Nailah Blackman (Trinidad den Tobago), Niniola (Nigeria), Not3s (Uk), Prince Waly (France), Sik-K (south Korea), Sjava (South Africa) den oda artistes.

BET use twitter announce Kwesi Arthur en nomination on Tuesday.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Kwesi Arthur win di 2018 Vodafone Ghana Music Awards Hip-Pop Song of di Year plus hit songs like 'Grind Day,' 'Ade Akye' den 'Anthem.'

Earlier when BET start announce nominations for dis year awards, people make concerned say no Ghanaian artiste get nomination yet, but after Kwesi Arthur en nomination di buzz for social media be positive as menerz dey root for am to win.

Di BET Awards go happen on TV live for Los Angeles, America coming June 24, 2018.