This is Nigeria: MURIC don warn FALZ to withdraw video

Falz inside di video

Wia dis foto come from, Youtube-Falz

Wetin we call dis foto, You go need to pay serious attention to di video in order not to miss all di message inside
Read am in 1 mins

Di Muslim Rights Concern (MURIC) for Nigeria don give musician Falz seven days to withdraw im 'This is Nigeria' music video or face legal action.

Na Less than one month afta America rapper Childish Gambino stop traffic wit im hit video 'This is America', na im Falz too carry di same leg release 'This is Nigeria'.

According to Falz, im borrow sense from wetin Gambino do to tell Nigeria tori, to draw attention to di issues wey Nigeria dey deal with.

Falz bin don explain di reason why im do di video and di message wey im bin dey try send give Nigeria and di pipo.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

But MURIC get problem wit some of di content of di video.

According to MURIC director Ishaq Akintola, di girls wey wear hijab dey dance Shaku Shaku for inside di video no in anyway represent di Chibok girls wey still dey Boko Haram hand.

Dem also get problem wit how di pesin wey dress like Fulani abandon im native guitar to go kill pesin.

MURIC say di video dey "thoughtless, insensitive and highly provocative," and fit cause religious and ethnic crisis.

Wetin we call dis Video, "My music get sense" - Falz The BahdGuy

"We no see any of di Chibok girls dey dance like say dem dey drunk. Dem get reason to dey happy? Dem dey happy?"

"Di video show ethnic bias against Fulani pipo and im no to anytin about wetin di militia for Middle Belt wey don kill Fulani dem and steal dia cow dey do."

"Na hate video wey fit cause religious crisis, e no respect Muslims dem, na misuse of freedom of expression," im tok.

MURIC also ask security and di regulatory agency to chook mouth inside di mata.

MURIC want make FALZ withdraw di video or im go hear am for court.