You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Super Eagles squad don get Jersey number for Russia 2018
Nigeria Super Eagles announce numbers for dia new squad on Monday afta Coach Gernot Rohr confam di 23 players di kontri football team go use play Russia 2018 World Cup.
Nigeria Football Federation (NFF) use video of all di players and dia jersey number make di announcement on top twitter.
Di tori land for Vienna, Austria wia dem tanda to begin train until dem enta Russia next week to play di 2018 FIFA World Cup.
All di 23 man squad wey coach Gernot Rohr put for list and dem coach follow land for Austria.
But Chelsea player Ola Aina and Porto Player Mikel Agu wey dem drop from di team no follow dem travel.
For anoda video wey di Super Eagles put for dem Twitter handle, Austria pipo do di team beta welcome as dem dey play music to welcome di team for Avita Resort Base Camp, Austria.
End of Di one wey oda users dey read well well
Nigeria Football Federation (NFF) tweet some of di picture wey dem take wen dem arrive for airport for NFF verified twitter handle.
Di Super Eagles fly comot from London after dem play friendly with England team for Wembley Stadium wey dem loose 2-1.
Na for Austria di Super Eagles go play dem next friendly against Czech Republic for Wednesday. Di team go waka go Russia for June 11, 2018. FIFA law tok say any team wey go follow play World Cup must land for host Kontri 5 days before dem first match.