You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Why transport money go go up for Ghana
Ghana Road Transport Operators don say as from Monday 4 July, dem go add ten percent ontop transport money.
Dis na afta tok-tok with goment wey bin reduce di fifteen percent increase we dem bin wan add before.
Di increase, according to statement wey dem release, na on top di rising price for fuel and oda money wey dem dey spend to transport pipo.
Di increase go affect tro-tro wey dey move for inside cities, transport from city to city and shared taxi.
According to di join bodi, dem for prefer di fifteen percent increase but dem agree because goment give assurance say dem no go allow di prices of di tins wey dem need for dem business to cost too much.