You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
National Day of Mourning: Waka don start on top kill-kill for Nigeria
Nigerians don comot for streets for some states across di kontri to mourn di more dan 3000 pipo wey don die for violent attacks.
From Abuja to Lagos to Zamfara states, organisers of di National Day of Mourning and Remembrance wear black clothes, cari placard, and say na goment work to protect di pipo and dem must do dia work well.
For Abuja, Nigeria capital, dem come out for di unity fountain wit black cloth to honour di memory of pipo wey die for Nigeria.
See pictures for places wey e dey happen: