You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
EFCC find yahoo boys enta club
Read am in 1 mins
Nigeria corruption police - Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) say dem don arrest 12 pipo wey dem suspect say dey do yahoo-yahoo for Lagos state.
Dem arrest di suspects afta dem raid Club 57, one club for di Ikoyi area of di state.
EFCC say di suspects abandon dia fine-fine cars run, but same dem seize 10 cars for di operation.