You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Port Harcourt Court don stop APC local goment congress on Saturday
Justice Chiwendu Nworgu of di Port Harcourt High court don grant order to stop di All Progressives Congress (APC) local goment congress wey suppose hold on Saturday 12 May.
Early dis morning supporters for one faction of APC for Rivers State bin cari protest waka go block di gate of di judiciary complex to try to stop di court to do dia work.
Di tin come turn anoda mata wen dem begin shoot gun, break di glass windows and doors of buildings wey dey for di courts and di windscreen of some moto wey park inside di court.
Pipo wey go court and lawyers dem get to run comot sake of bullet wey bin dey fly up upandan before police come arrest di situation.