You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nigerian professor don find 2 new malaria medicine
One Nigerian professor, Umar Katsayel wey dey teach for faculty of Pharmaceutical sciences for Ahmadu Bello University, Zaria, don find two Anti-Malaria medicine.
According to di professor, di drug fit compete wit any medicine for world wey dey treat malaria parasite.
Katsayel, tell local news agency NAN say, im make di medicine from root of Cissampelos Mucronata and di back of frangipani tree (Plumeria rubra) plant.
Dis plants dey very common for plenti community and some dey grow like grass sef.
E explain give say, di drugs don go through plenti exam for lab to know how good dem be before pipo go begin use am.
Im announce say, im go soon make di medicine public afta dem don check am wella and all di agency wey suppose, don approve am.
Katsayel say, time don pass for di kontri to dey depend on white pipo to find disease plus find medicine to treat am.
Malaria na big gbege for Nigeria and almost 400,000 thousand pipo dey die of di disease everi year.
End of Di one wey oda users dey read well well
Statisctics also show say one pikin dey die from malaria every two minutes.