You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Mama sell im son 300,000, pesin wey buy re-sell am for 350,000 - Police
Enugu State Command of Nigeria Police Force say, dem dey chook for di mata of one baby boy wey dem say im mama sell for N300,000 and di pesin wey she sell am give, come re-sell di pikin for N350,000.
Public relations officer for di command, Deputy Superintendent of Police, Amaraizu Ebere, tell BBC Pidgin say, dem don arrest two suspect on top dis mata.
Dem arrest di mama wey dem accuse say im first sell di pikin, and di pesin wey she sell am give wey come later go re-sell di pikin for 350,000.
E say both di mama, Nwanneka Ezechi and di oda pesin don dey help di police with dia investigation to find di last buyer and di pikin.
According to di statement wey di police PRO carry come out, Nwanneka Ezechi wey be 30 years old bin get belle for one man and later run comot from her family house go where nobodi sabi.
Then for November 2017 she announce say, she don born baby boy.
But she no show di pikin give her family members wey don already dey suspect say something bad don happen as she reappear witout di pikin.
Nwanneka parent na im come go report di mata give police and as police get di information, dem arrest her plus one Okechukwu Nyia wey she confess say she sell di pikin to.
End of Di one wey oda users dey read well well