You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
J. Cole for Lagos: Nigerians dey vex for Americans
US rapper, J. Cole don do wetin no American act don ever do before.
On Friday, im come do im first concert since im release im new album, KOD for Lagos Nigeria.
E shock di rapper how after one week wey di album don drop, Nigerians bin dey join am sing di songs like say dem follow am write di album.
But Nigerians don start to dey vex afta Americans start to dey yab dem for social media.
Na one Hip Hop music media group, wey dem dey call World Star HipHop post video of im performance for dia domot.
E be like say Nigerians no fully like di way wey Americans take di news say J. Cole do concert for Nigeria.
As Nigerians no dey carry last, na im dey give am back.