Headies Award 2018: Simi go battle Tiwa Savage for Artiste of di Year Award

Wia dis foto come from, NdaniTV
Nigeria musician Simi career just dey go up evri day as her album 'Simisola' dey carry weight wit so many recognition.
Di singer wey her real name na Simisola Bolatito Ogunleye dey lead di females for Headies Award dis year, wey go happen May 5 2018 for Lagos.
Simi go battle with Tiwa Savage to win di Artiste of di year award.
Simi collect six nominations wit her hit song, Joromi, plus Best Recording of di Year category.
Other female artistes get three-three nominations each.
Beside Joromi, her song 'Gone for good', collect nomination for Best Vocal Performance (female)
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
All di categories wey dem nominate Simi for
Simi bin win Best Collaboration Headies award for di song 'soldier' wey she do with Falz for 2016 and Best Vocal Performance (Female) for 'Love don't care' for di same year.
But di 29-year-old X3M Records artist fit win more Headies awards dis year.
End of Di one wey oda users dey read well well
- Best R&B/Pop album - Simisola
- Best R&B single - Smile For Me
- Artiste of di year - Simi
- Album of di year - Simisola
- Best recording of di year - Joromi
- Best Vocal Perfomance (female) - Gone For Good

Wia dis foto come from, Getty Images
Five African artiste sef dey part of di pipo wey dem nominate to win African Artiste of di year for di Headies Award.
Ghanaian rapper Sarkodie, Kenyan afro-pop band Sauti Sol, South African rapper Cassper Nyovest and South African female singer Vanessa Mdee go battle to win di African Artiste of di year award.










