You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Swaziland king don change di country name to di Kingdom of eSwatini'
Swaziland King Mswati III don change im kontri name from Swaziland to eSwatini.
Di king announce di new name for im 50th birthday celebration and di country 50 years of independence.
Ngwenyama na name wey dem dey call di king, e mean "di lion", di king get many- many wives dem.
eSwatini, mean "land of di Swazis".
Swaziland na part of Commonwealth.
BBC Nomsa Maseko for Swaziland say di announcement vex people well-well for di kontri, dem believe say di king suppose focus on dia economy.