You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
South Sudan don close BBC stations sake of money dem owe
Authorities for South Sudan don close BBC FM relay stations for inside di country capital, Juba and for Wau.
South Sudan Broadcasting Corporation (SSBC) oga, Magok Chilim, say BBC bin ignore requests to "pay money dem dey owe", afta di authorities remind dem for January.
Di oga threaten to carry BBC go court if dem no pay dia bill.
For statement, BBC say dem regret SSBC decision to stop dem from broadcasting "dia tori services to audience of more dan 400,000 inside South Sudan".
BBC say dem dey work hard to reach agreement with SSBC to bring back di service.