Nigeria Senate say na Senator Ovie Omo-Agege arrange pipo wey steal mace

Read am in 1 mins

Nigeria Senate say na one of dem, Senator Ovie Omo-Agege bring pipo wey carry force enta dia chmaber carri di mace run.

Senate talk-talk pesin Senator Aliyu Sabi Abdullahi say wetin di Senator do na "act of treason, and na attempt to overthrow one branch of di Federal Government of Nigeria by force,."

Di statement say make all security agencies "stand on di side of due process and immediately mobilize dia personnel to collect di mace and catch di pesin wey plan am and pipo wey do am."

Di Senate dey for Executive session.

Di mace na very powerful tool for Nigeria legislative process and e dey show power and authority and if e no dey, any law wey dem pass no go stand.

BBC neva fit reach Senator Ovie Omo-Agege but im bin enta one trouser with di leadership of senate wen e go tell press pipo say di upper chamber bin dey change di electoral law because of President Muhammadu Buhari.

Afta Senator Dino Melaye report am for di floor of di house, dem bin give am 181 days suspension but afta plenty I-beg, di senate president, Bukola Saraki come reduce am to 90 days.