You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Dem don kill anoda Nigerian for South Africa
Nigerian community inside South Africa on Friday report say pipo wey take into dia hands don kill one Nigerian man.
Habib Miller, publicity secretary of Nigeria Union inside South Africa confam give News Agency of Nigeria say na one ThankGod Okoro dem kill.
Tori be say Okoro from Ogbaku for Awgu local government area of Enugu state south-east Nigeria
Di killing of dis man na di latest inside di murder of young Nigerians for South Africa.
Na at least 117 Nigerians n aim dem don kill for South Africa since February 2016.