You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nigeria: Gunmen don kill six pipo for Kaduna attack
Gunmen wey dem suspect say na herdsmen don kill six pipo for Kaduna wey dey north central Nigeria.
Tori be say di gunmen reach like 10 and na army and police uniform dem wear take do di attack.
Tori pipo, Vanguard, say one pesin wey dey dia when di thing happen, Auta Maurice, talk say dem kill three pipo for bush as dem dey find wood wey dem go use for roofing and kill anoda three for wia dem dey do mining.
Four pipo wound for di attack and dem don carry dem go hospital.
Police neva confam wetin happen.