You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Why Brymo wear 'G-string' for im new video
- Author, Faith Oshoko
- Role, BBC News Pidgin
- Read am in 2 mins
Popular Nigeria singer Brymo don drop new album for market wey im call 'OṢÓ' wey mean wizard.
But no be dis im number six album, wey pipo don already praise say e good well-well, dey cause katakata for social media, na di video for di first song from di album wey im call "Heya".
Reason be say im bumbum show well-well for di video and pipo don watch am 6,000 times just one day after im post am.
Wetin people talk for social media?
Argument don bust on top whether dem fit call dis kain thing art or sumtin else. Some dey hail am...
Odas dey nail am.
So, na creativity or craze?
Brymo imsef follow BBC Pidgin talk. Im say di message for di song na to show say "my people still be bush people for inside dia mind.
"Because civilisation surround us, we think say we dey inside di civilisation but no be so."
Di singer also talk say e try to imagine how e go be if bush man from olden days enta big town, dat na why e wear wetin e wear.
End of Di one wey oda users dey read well well
Brymo chook mouth for wetin pipo dey yan for social media say "people no know wetin dem want, until dem see am."
And e say e no go hard am to wear di 'G-string' wey im wear for di video perform for live stage.