Cameroon: Governors for Anglophone regions stop waka for senatorial election day

Cameroon elections

Wia dis foto come from, AFP/Getty Images

Read am in 2 mins

Election for Anglophone regions de pass without waka about as governors stop movement for pipo and dia property.

Counsellors for de two regions dem go vote for senators for tight security and only official motor go waka, man weh e break de go hear nweng.

One of de centres wey dem counsellors go for vde voting
Wetin we call dis foto, One of de centres wey dem counsellors go for vde voting

Na nine political parties go try for grab de 70-senatorial chair dem and president Biya go appoint de remaining 30 for complete de number.

For Northwest, governor Adolphe Lele Lafrique stop bensikin dem for waka from 6:00am till 9:00pm.

Pipo and dia property no go move from one division to anoda for de same time.

Dis be some of de pipo wey comot to vote
Wetin we call dis foto, Dis be some of de pipo wey comot to vote

Den governor Benard Okalia Bilai for Southwest sign e own say from 8:00pm last night go reach for 8:00pm dis evening for Southwest.

De two governors say mbere khaki motor and ambulance plus oda pipo weh get authorisation weh competent authority sign, SDO or DO, dem go fit waka.

Any man weh e wan try dis order go hear nweng for de two regions dem and de mbere khaki go show dem pepe.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

De election di pass weh de moni weh gofment promise, e nova give political party dem just now.

Even as e dey so, some Amabzonia forces di warn say any counsellor weh deh go catch'am say e di kam vote go hear yi own.