Calculate Your salary vs Senator allawee
E no too tay wey Shehu Sani, di senator wey dey represent Kaduna Central talk say im and im colleagues dey collect N13.5 million allawee every month.
Im say di money na to maintain dia office and salary and oda allawee no dey inside.
Di money small or e too much?
How much you sef dey collect for ya work?
Oya, compare ya money with senator own.







