Dapchi Girls: Boko Haram don return kidnapped schoolgirls

Di Dapchi schoolgirls wey dem kidnap last month for Yobe State don return house.

Tori be say na Boko Haram enter di town, drop di girls den vamoose comot.

Talk-Talk for person Nigeria President Garba Shehu confam say dem don return di girls

"I fit confam say dem don release di girls," na di only word im talk ontop di mata.

No extra tori on whether di number of girls or how di mata happun.

E pass 100 girls wey Boko Haram kidnap from Government Girls Secondary School, Dapchi.