FIFA World Cup tour: Di trophy show for BBC office Lagos
On Friday 9 March di FIFA World Cup trophy land den come visit BBC office for Lagos.
Di staff dem and some of di pipo wey dey follow BBC News Pidgin for social media show come follow jolly say di trophy don Land for Nigeria and e come Lagos.
Timi Dakolo wey dey sing too follow come see di trophy and him happy wella.
