FIFA World Cup trophy don enta Nigeria

FIFA world cup trophy

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di world cup trophy go enta di BBC Lagos office

Football fans for Nigeria go get di chance to touch di 2018 FIFA World Cup trophy live and direct as di world cup don touch down for Abuja, from where e go enta Lagos.

Nigeria dey part of di African countries wey di world cup trophy go travel go.

Nigeria Super Eagles team

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Nigeria na one of di African countries wey dey play for di 2018 FIFA world cup

Di world cup trophy go first enter di BBC Lagos office on Friday 9 March before FIFA go carry am go di Teslim Balogun Stadium for Surulere, Lagos.

FIFA do collabo with Coca-Cola to bring di trophy come Nigeria for thousands of fans wey neva see di gold trophy before.