Ugandans wan 'domestic abuse' lawmaker to resign

Mr. Onesimus Twinamasiko

Wia dis foto come from, NTV Kenya

Wetin we call dis foto, Kenya lawmaker Mr. Onesimus Twinamasiko
Read am in 2 mins

Ugandans wan di lawmaker, wey talk say e good for husbands to beat dia wife dem, to resign.

Mr. Onesimus Twinamasiko, wey dey represent Bugangaizi East County MP for Uganda, cause kata-kata after im talk say husbands suppose dey beat dia wife dem to teach dem lesson wey go give dem sense.

"If you be man, you suppose discipline your wife…touch her small, fight her, and beat her so she go get sense,'' Twinamasiko tell local station NTV.

Di speaker of Uganda parliament Rebecca Alitwala Kadaga don tell di Rules, Privileges and Discipline Committee to investigate di lawmaker on top domestic violence.

Onesimus Twinamasiko

Wia dis foto come from, SIMON MAINA

Wetin we call dis foto, Twinamasiko talk say im don slap im wife before

But Twinamasiko don do u-turn for BBC interview yesterday.

"No be beating wey go cause injury or death l dey talk - but na slap - dis one go make me feel fine! Because e go call me to order. We go siddon and try and find solution.

"One time l slap my wife and e dey fine with am because later we nack head together, find solution to our wahala.

Twinamasiko don enter hot soup for social media with dis talk im talk, sotay one top women rights group for Uganda talk say im suppose enter brain hospital.

"Mr Twinamasiko suppose beg all women wey don experience violence," Diana Kagere for di Center for Domestic Violence Prevention (CEDOVIP) tell di BBC.

Sexual violence in Kenya

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Sexual violence na one mata wey dey give Kenyan women headache

Social media no waste time as dem react to di short video wey don spread for internet.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

While some people dey support wetin Mr Twinamasiko talk, others dey use di hashtag #OnesmusTwinamasikoMustResign:

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Skip X post, 3

End of X post, 3

Skip X post, 4

End of X post, 4

Skip X post, 5

End of X post, 5

More than one in every five women between di age of 15-49 dey experience domestic or sexual violence for Uganda, according one government report for 2017.