DR Congo don do strong thing to big mining companies

Wia dis foto come from, AFP/GETTY
Di Democratic Republic of Congo don arrange ground to add tax money to companies wey dey do mining for country.
President Joseph Kabila sign di new mining code as law on Friday.
Ontop of tax, royalties (government settlement money) go also increase.
Di international companies wey dey work for DR congo no like dis mata at all.
DR Congo na di biggest producer of natural minerals like copper and cobalt (wey dem dey use for phone battery).
Foreign companies no like di law at all as dem say e go affect dia profit.
Plenty of dia oga dem bin fly enter Kinshasha, Congo capital say make make President Kabila change e mind but dat one no happen.
Reuters bin talk say some of wetin di phone oga people tell di president be say, di new tax law fit spoil future investment mata plus all di agreement wey dem bin don sign before-before.
End of Di one wey oda users dey read well well
No be today, wey DR Congo say dem wan change dia mining law wey don dey ground since 2002.












