Ghana: National security sama people near Nana Akufo-Addo house quit-notice

Wia dis foto come from, Getty Images
Ghana National security don sama people wey get shop, wey dey do business and wey dey stay around di personal house of di president Nana Akufo Addo quit notice for security reason.
Dem get one week to pack comot di area.
But dem no go go empty handed. Dem go collect compensation from GHc 3,000 to GHc 10,000.
Many of di traders dem say di compensation no reach, some say dem don dey do business dia for many years so wia dem one take start from again.
People for Ghana too dey react to di tori ontop social media. As some gree say na di right thing dey happen so, other people dey wonder how e go affect di shop owners and di business peole wey just dey manage demselves before.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2
Dis mata don cause people to dey ask again say why di president still dey live for im private house.