You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Lassa fever: Tanker mate be first casualty of Lassa fever, GHS start investigations
Ghana Health Service (GHS) begin dey investigate how Lassa fever patient who be tanker mate die for Tema General Hospital.
Di mate visit four regions for Ghana in three weeks, Eastern, Volta, Brong Ahafo den Greater Accra Region.
Sake of dis, Dr Badu Sarkodie, Director of Public Health for GHS say dem send people from di field and technology training program for di public health school make dem go investigate how di disease enter Ghana.
Di other thing di health officials go try uncover be how di Lassa fever infect di deceased.
According to Dr Sarkodie, dem begin dey monitor relatives den health officials wey come into contact plus di patient for Tema General Hospital.
Ghana Health Service say dem intensify education den sensitization so say Ghana no go record more cases.
End of Di one wey oda users dey read well well