You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Burkina Faso attack: Ouagadougou dey under attack
Burkina Faso government don talk say dem don kill four of di attackers wey attack di capital city Ouagadougou.
People for di city talk say dem hear one explosion and gunshots near di army headquarters, Institute Francais and di French embassy.
Dem say dem see around five men wey carry gun dey shoot as dem drive go di embassy.
Di French ambassador put di tori for social media say, "Terrorist attack dey happen right now".
According to di French embassy Facebook page, dem no sure which area di attackers dey target.
Foto wey dey comot for social media dey show as big black smoke dey rise enter di sky.
As things dey, e no sure who dey do di attack.
Di national police don talk say, di Burkina Faso special forces don begin counterattack.
End of Di one wey oda users dey read well well
Mayor Armand Béouindé tell France Le Monde newspaper say di attackers shoot di town hall and scatter im office window.
Béouindé don talk say "E fit be jihad attack''.
Di US embassy for di Ouagadougou don advice people to hide.
Islamist militants don attack Ouagadougou two time in di last two years.