Nigeria: Dino Melaye go show for court, get N100k bail

Wia dis foto come from, Dino Melaye/Instagram
Nigerian senator Dino Melaye show for court today for Abuja, di Nigerian capital.
Di case wey Dino Melaye dey go answer for court na say im lie give police say Edward Onoja bin try kil am for April 17, 2017. Di state say oga Dino dey lie on top Onoja head.
Senator Melaye plead not guilty to di two charges wey di Office of the Attorney-General of di Federation file against am on 31 January.
Justice Olasunbo Goodluck, give bail to di Senator, say make im pay N100,000, with one surety wey be person wey go stand gidigba to make sure say Senator Melaye return to court.
Plenty protesters and senators like Ben Murray-Bruce bin dey street with placards to show support for di Kogi state senator.
Local media report say e reach 11 senators wey follow Melaye enter court.






