Corruption Perception Index: EFCC no suppose ignore 2017 report - Transparency International

Wia dis foto come from, PIUS UTOMI EKPEI/AFP
- Author, Onyinye Chime
- Role, Broadcast Journalist, BBC News Pidgin
- Read am in 1 mins
Nigeria Economic Financial Crimes Commission (EFCC) no suppose take 2017 Transparency International (TI) report play. Dis na wetin Auwal Ibrahim Musa, di Head of Transparency International for Nigeria, yan with BBC Pidgin tori person Onyinye Chime.
Even with President Muhammadu Buhari zero tolerance to corruption campaign, TI report show say, di kontri still never comot from list of one of di most corrupt kontri for world.
Di report show say Nigeria carry 148 position wey make am di 32 most corrupt knotri for world out of 180 kontries wey dem chook eye for dis year.
Nigeria position for last five years:
Auwal say im no dey surprise because di way wey di kontri local, state and federal government dey take handle corruption mata, dey "frustrate" di work of di anti-corruption commission.
Im say, inside all di arrests well EFCC don do since dia fight against corruption, dem never ever expose even one person wey steal government money.
Dis report dey wonder how far with fight against corruption wey don dey happen since Buhari enter office.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2

End of X post, 3