Dana passenger: If weather bad, why dem allow pilot to land?

Dana plane

Wia dis foto come from, Pepple Noble

Wetin we call dis foto, Di Dana plane wey bin land for inside bush on Tuesday night
Read am in 2 mins

One passenger wey bin dey di Dana plane 9J0363 wey bin dey fly from Abuja go Port Harcourt, say fear bin catch am and everything happen "quick-quick."

On Tuesday evening, one Dana plane bin run pass runway come land inside bush for di Port Harcourt airport, south-south Nigeria.

One person wey im name na Awuam wey talk to BBC News Pidgin, say passengers inside di plane bin first think say dem don land safely.

"Panic full everywhere, as we come dey smell one kain thing inside di plane. People just dey cry, dey pray, dey call God.

"I bin siddon for window side, so I see say we don land. But instead of di plane to reduce speed, e still dey run with force until e enter bush.

"We jam di iron barb wire dem wey dey di airport until we enter bush.

Di Federal Airports Authority of Nigeria FAAN, and Dana, bin release different statements say na di bad weather bin make di plane run pass di runway.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Awuam say im happy say rain bin dey fall because of fire and sparks. Im say if to say ground bin dey dry, di impact for fit cause spark.

But im still get questions for FAAN on top di weather mata.

"Na dat one bi di only plane wey land? Plus why dem no tell di pilot to go back if di weather no dey go enough. I no believe dem, but I not fit say wetin happen."

"As everything dey happen, I come dey think if dis na how I go die. But when we enter bush, my mind come strong say di plane no go catch fire."

On 7 February dis year, door bin fall comot from one Dana plane wey bin dey go from Lagos to Abuja.