You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
South Africans dey wait Zuma to hear wetin im go talk
South Africans dey wait to hear whether President Jacob Zuma go resign after di ruling African National Congress, ANC, talk say im go talk to im country people today.
Di country dey sidon look di drama as e dey happen after ANC comot from dia meeting yesterday to tell Mr Zuma say dem wan make im comot office.
ANC say di president go tell im country people today how im wan do am.
But di information wey dey im official website say na one awards ceremony im dey go, nothing else.
People - di ruling ANC, opposition party dem and even trade union people - don dey increase di pressure on top Mr Zuma head.
Im party don already demand say make im step down immediately.
Di opposition say dem go motion for 'no confidence vote' for parliament.
Now, trade union people for South Africa say power dey shack di president.
End of Di one wey oda users dey read well well
People wey support Mr Zuma talk say dem suppose give am time to arrange how im go comot.