Benue attack: Dem don recover police dead bodi

Police vest

Wia dis foto come from, Quentin Leboucher/AFP/Getty Images

Wetin we call dis foto, Security na problem for Benue State because of di Fulani herdsmen attack.

Dem don recover di deadbodi of one of di two policemen wey bin dey miss for Benue State since Saturday.

Local media dey report say police find di dead bodi for serious bad shape.

Police don talk say dem dey on top di matter to ensure security of live and property for di state.