Commonwealth don welcome back Gambia as dia member

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Commonwealth don welcome Gambia back as member, almost five years after di country leave di organization during wen former President Yahya Jammeh dey for office.
Di organization even do flag-raising ceremony for di Commonwealth headquarters wey dey inside central London to mark di occasion. as this tweet shows:
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
President Adama Barrow apply make dem re-admit Gambia join di group after e enter office last January.
Di former president Jammeh bin get clash with di Commonwealth because of im government poor human right record.
Di commonwealth secretary-general- Patricia Scotland talk say:
"All di 52 member states support Gambia application to re-enter, and dem welcome back dia brothers and sisters to come play dia full part inside di Commonwealth family."
AFP news agency report say di Gambia ambassador for London- Francis Blain talk say dem dey hope to contribute and benefit from di "collective wisdom "from all di country wey make up di body.

Wia dis foto come from, Getty Images
Zimbabwe dey also consider to re-apply for membership inside di Commonwealth, after President Emmerson Mnangagwa enter office late last year.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dem be leave Commonwealth 2003, after former Robert Mugabe accuse say di United Kingdom don hijack di organization and dem dey plot against im government.
Di Commonwealth don first suspend Zimbabwe membership, after violence and accuse of rigging spoil di presidential elections.
Gambia go be di fourth country wey don return back to di Commonwealth - after South Africa, Pakistan and Fiji.












