UN dey raise alarm over hunger for 9 African countries

Wia dis foto come from, Getty Images
Two United Nations (UN) agencies wey be di Food and Agriculture Organisation (FAO) and World Food Programme (WFP) don draw ear over di kain hunger wey dey nine African countries.
Di African countries wey dem list na Burundi, di Central African Republic (CAR), di Democratic Republic of the Congo (DRC), Guinea-Bissau, Liberia, Mali, Somalia, South Sudan and Sudan.
While Afghanistan, Haiti, Iraq, Lebanon, Syria, Ukraine and Yemen na di other countries wey hunger dey affect.
UN say na di plenty wars wey dey happen for all dis countries cause all di hunger and dem need food seriously.
For Yemen, South Sudan, Syria, Lebanon, CAR, Ukraine, Afghanistan, and Somalia, e pass quarter of di population wey dey face serious hunger crisis.
Di report say di number of people wey hunger dey wire for world rise reach 815 million for 2016.
End of Di one wey oda users dey read well well










