African Union summit: "Paul Kagame work no go easy" - Analyst

Rwanda President Paul Kagame

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Rwanda President Paul Kagame go start work as African Union oga
Read am in 2 mins

Rwanda President, Paul Kagame don chair A.U summit for di first time since dem elect am for July 2017 to take over from Guinea's president Alpha Conde.

E say im vision na to build strong and united African Union wey no go depend on foreign people for money.

But African Affairs Analyst, Moses Tedeke say although e don do better thing for im country and plenty Africa people respect am, e no get di political muscle to make oda African leaders follow im vision.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Dis one happen as African leaders land for Addis Ababa, Ethiopia capital for di 30th A.U summit, to chook mouth on top corruption matter and see how dem go fight am.

But Tedeke say African leaders go only win di war against corruption if dem fight imperialism.

Tedeke tell BBC Pidgin say colonial masters bin no create better condition wey go help Africa get better leaders wey suppose di continent.

'Corruption dey well-well for Africa politics and economy and dis na because di colonial master bin give power to people wey go do wetin dem want and dis one don increase corruption for Africa. If dem no fight imperialism wey be headmaster of corruption, Africa no fit free from corruption'.

African Union conference

Wia dis foto come from, Getty Images

HOW AFRICA FIT DEVELOP

E say African leaders must put money for education and make am change to crititical thinking wey African people fit sidon think about how dem go solve dia problem.

E come add say di change go start primary to university.

Tedeke come explain say African countries suppose unite and share intelligence and technology so dat dem go grow like Asian countries.