"Corruption dey make young people join bad gang" - Buhari

Wia dis foto come from, Getty Images
"Corruption na di greatest evil wey don happen for our time".
Na wetin Nigeria President, Mohammadu Buhari, talk as im launch di African Anti-Corruption Year 2018 for di African Union summit wey dey happen for Addis Ababa, Ethiopia.
As plenty African leaders gather for Addis Ababa, na how to fight corruption be di main focus dis year.
Na United Nations Economic Commission first start to talk di mata when dem tweet say "corruption don hold Africa back too long and time don reach to stop am".
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Na di Nigerian president dey champion di campaign wey di African leaders wan do dis year.
Mr Buhari talk say true-true, corruption don spoil plenty things and don cause make young people and communities suffer.
Im say na corruption dey cause make some young people join bad gang like militants and armed groups because e no allow dem do beta things with dia life.

Wia dis foto come from, Getty Images
Na for dis AU summit Guinea President, Alpha Conde, go officially hand over as African Union chairperson to Rwanda President Paul Kagame.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Getty Images
Mr Buhari say e dey ginger am as im fellow ogas don give am dis job to champion di fight against corruption. But e warn say e no go easy as corruption sef go "fight back".










