You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Tagoe v. Dagboe: Na wetin Ghanaians want?
Manager of boxer Emmanuel "Game Boy" Tagoe, Baffour Gyan, don warn say make Isaac Dagboe no dream to fight im client as im no go pass three rounds if e try am.
Dis na as "Game Boy" Tagboe bi defend im IBO world lightweight title as im win Argentine, Fernando Saucedo for wetin many people dey call "controversial stoppage" for di tenth round.
Many people dey think say dem go soon fight but Gyan talk say e go be really easy fight for Tagoe.
Meanwhile, Ghanaians don put mouth on wetin go happen during di fight but every body gree say di fight suppose happen.
Dis person think say wetin Gyan talk no make sense.
Dis person wan make di fight happen.
Dis person think say na Dogboe go win di fight.