CHAN quarter final results

The African Nations Championship (CHAN) trophy

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, CAF comot 2018 African Nations Championship hosting right from Kenya because dem no meet di requirements

Host Morocco and Sudan don book dia semi-finals ticket for di African Nations Championship.

Morocco beat Namibia 2-0, while Sudan nack Zambia 1-0 for Saturday quarter final match dem.

Sudan go jam di winner of Sunday quarter-final match between Nigeria and Angola.

Di winner between Congo-Brazzaville and Libya dia quarter-final match on Sunday go play Morocco.