You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Burna Boy don come 'Outside' with first major album for 2018
Afro-fusion music artiste, Burna Boy don drop brand new album wey im call 'Outside' dis January.
Dis go be di first album of any major Nigerian musician dis year.
Dis na Burna Boy first album under Atlantic Records.
Before im drop am, im bin comot new song wey im call "Heaven's Gate" wey already dey market well everywhere. Di song na single off di album wey get twelve tracks.
Di album drop on 26 January and before dat time, im do listening party for Lagos and London. E get features from Lilly Alen, Mabel and J-Hus.
Already, di album don dey create buzz for social media.
Dis one don already pick im favourite from di album.
Dis one dey happy with all di artistes dem wey dey help to push di music go front.
End of Di one wey oda users dey read well well