Herdsmen killings: "Na because dem block cow road" - Defence Minister

Cow tanda for field

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 2 mins

"We know say road bin dey wey cattle rearers dey use because dem dey everywhere for di country. You go Bayelsa, Ogun, you go see dem. If dem block am, wetin you think say go happen?"

Na wetin Nigeria Minister of Defence, Mansur Muhammad Dan-Ali, talk after im comot for di National Security Council meeting with President Muhammadu Buhari for Abuja.

Benue women dey cry for burial of people wey die when herdsmen attack villages for di state

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Benue women dey cry for burial of people wey die when herdsmen attack villages for di state

Plenty people don die for Benue, Kaduna, Taraba and Plateau states after attacks wey dem say na Fulani herdsmen do.

All di fight-fight na between cattle rearers wey dey carry dia cow waka about to chop grass and farmers wey dey talk say dis herdsmen dey enter dia land destroy everything.

Dan-Ali tell tori people for Abuja say di herdsmen be Nigerians too and e no good di way some people dey block road wey dem dey pass with dia cow.

"Dis people be Nigerians. E be like say make you go block sea, dat one make sense? Dis na wetin dey cause di palava. But di wahala wey dey now-now na di grazing law. Dis people be Nigerians and we suppose learn how we go live together. Communities and other people dem suppose sabi how to accept foreigners for dia domot. Finish!

Vigilante people for Bakin Kogi, Kaduna state, northwest Nigeria dey look di damage after herdsmen attack di village on 24 February, 2017

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Vigilante people for Bakin Kogi, Kaduna state, northwest Nigeria dey look di damage after herdsmen attack di village on 24 February, 2017

Some people for social media no like wetin talk.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Tori people wey dey dia ask am whether im dey talk dis kain thing to do excuse for di kill-kill wey don happen, but im say di mata na security mata for di country and di grazing law join wetin dey cause all di kill-kill.

Benue governor Samuel Ortom

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Benue governor, Samuel Ortom, don talk say di anti-grazing law wey im state get na to protect herdsmen and farmers dem

Some states like Benue - wey over 70 people die after herdsmen fight-fight - and Ekiti get anti-grazing law wey ban cattle rearers to dey carry cow waka anyhow.