You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Australian High Commissioner dey complain about dirty for Ghana
Read am in 1 mins
Di Australian High Commissioner to Ghana, Andrew Barnes don challenge authorities for di country make dem up dia game to make di country clean.
Barnes want make di authorities begin work hard to meet di promise wey Ghana President Akufo-Addo get to make di Accra di city wey clean pass for Africa by 2020.
Na on top social media Barnes enter to write as di dirty wey near di High Commission dey vex am.
Dirty don full di gutter wey dey front of di High Commission office upon all di signboard wey dey warn people make dem no troway dirty for there.