Liberia: George Weah don become new president

Wia dis foto come from, Getty Images
Liberia don swear-in former international footballer, George Weah, as new president.
Dis na special time for di country wey don get dia first peaceful handover of power from one democratic government to another one since 1944.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Weah na di 25th president of dis West African country, after im collect power from President Ellen Johnson Sirleaf.

Wia dis foto come from, Getty Images
Liberians dey hope and pray say Weah go deliver im promise of jobs and better schools.

Wia dis foto come from, ISSOUF SANOGO /AFP/GETTY
Di swearing-in ceremony happen for di Samuel Kanyon Doe stadium near di capital, Monrovia.
Some of di VIPs wey suppose show include African presidents from Ghana, Mali, Nigeria and Togo plus friends and former colleagues from Weah football time.
Weah play im football for Europe for di 1990s where im become di first and only African wey don win di FIFA World Best Player award and di ogbonge Ballon d'Or prize for 1995.

Wia dis foto come from, Getty Images
After Weah lose di presidential election against Sirleaf for 2005, im don spend di last 13 years, dey grow im political muscle, sotay im become senator for 2014.
End of Di one wey oda users dey read well well
Liberians talk say dem go remember President Ellen Johnson Sirleaf as di person wey help give peace stamina after di 1989-2003 civil war palava wey kill at least 250,000 people.
But poverty, education and health matter don put Liberia among di poorest country for world.











